09/07/2026
Because today na Thursday make I throw una back to 1998 when goal post nearly d!sgrace Real Madrid for Champions League.
Back in 1998, Real Madrid vs Dortmund bin get Champions League semi final match and na for Santiago Bernabéu Stadium dem go play di first leg.
Normally, dem use something like metal chain take fence di goal post side so that fans no go dey worry goal keepers and as dem fence am dem come chain am with di goal post join.
As Real Madrid fans dey try hang banners for di fence naso dem use mistake drag di fence backward wey make di goal post follow fall.
Omo, as post break, no another post for stadium, Dortmund don already dey para say make UEFA abandon dey match give dem 3 goals because na 2-3 mins before di kick off.
Real Madrid try make dem dig hole put di post back e no gree stand, dem try use plank take support am but di post no gree enter oo, dem call welder man hin number no go.
Omo naso one Real Madrid goal keeper and plenty other people remember say dem get goal post for Real Madrid training ground naso dem enter motor with police es**rt rush dey go training ground.
As dem reach, to carry di goal post come become problem luckily dem come see one man wey pack hin van dey enjoy 1-2 bottles for one bar wey dey near di training ground.
Naso dem hire di man, use hin van take carry di post reach there stadium, dem get luck say no be my kwantri person because di kind billing wey e go knack dem since e even know say e dey urgent.😂
Las las, match wey suppose start by 8:45pm later start by 10pm and Real Madrid later win di match 2-0.
My people if na you be di driver wetin you go do ?😂