02/05/2025
Wetin be GDP wey dem always dey shout?
You go just hear: “Nigeria GDP grow by 3%”, and you go dey wonder, “wetin concern me?”
GDP simply mean the total value of all the work, business and hustle wey happen for a country within a time.
If e high, dem go say economy dey grow.
If e low, dem go say economy dey slow.
But wait… no be everything GDP dey show.
Make we break am down from tomorrow. E go shock you say Nigeria GDP fit rise, but you still dey suffer.
Follow this page, make we Xplain am together.