17/06/2026
Today in history
On dis day for 17 June, 1885, di Statue of Liberty, arrive New York.
According to history, di statue na gift of friendship from di pipo of France to di pipo of America.
Dem complete di statue for Paris for 1884, designed wit robed female figure wit arm wey dey lift torch.
Di statue alone cost France about $250,000 (more dan $5.5 million for today rate.
Wen di statue reach New York and dem put am togeda, e weigh up to 450,000 pounds as President Grover Cleveland officially dedicate am on October 1886.
Na French sculptor Frederic-Auguste Bartholdi design di statue and model am afta im own mama.
Later on engineer Gustave Eiffel, wey assist di sculptor, bin develop di iconic tower for Paris to bear im name.
Di statue na originally copper-coloured, but ova di years, e go through natural colour-change process.
11/06/2026
10/06/2026