05/04/2026
Judas sell Bros J collect money, and dem arrest am. (Matthew 26:14-16)
Dem judge am with lies, beat am, mock am, and nail am for cross.
Even for that pain, bros J still forgive them. (Matthew 27:22-35, Luke 23:34)
Bros J come Kpai and dem bury am.
Hope look like say e don finish.
(Matthew 27:59-60)
But on the third day, everything be like say nobody die…
The tomb empty.
Bros J don rise, Dey waka for street
(Matthew 28:5-6)
This mean say Bros J, carry your sin and pain go cross, and by him resurrection, e give you new life and hope.
No matter wetin you dey face…
Know say Bros J Dey for you, na why him comeback. ✨
Happy Easter country people.