Law In Pidgin Family TV

Law In Pidgin Family TV

Share

Welcome to LAW IN PIDGIN FAMILY TV where I create healthy family contents.

22/05/2026

Na Okro or Okra?
Make we settle this matter now.

Photos from Law In Pidgin Family TV's post 22/05/2026

A or B?
Okro soup or ogbono soup?

Na me cook the two.

22/05/2026

My mama na old school mama but me I be Gen Z mama.

Sometimes, me and am no dey agree for some kind thing. 😂

My mother say if hiccup Dey worry Ekwnubialam, make I put small rope for him head. Na so she Dey put too.

But me I no dey gree. I tell am say hiccup go stop when e go stop whether you put that thing or you no put am.

Who even teach our mothers all these things?

22/05/2026

Mama Ekwnubialam, I born 5 pikins for my husband but him never marry me.

I dey do business for market still dey help am for house.

Now, him say make I go say him don see person wey him love and wan marry.

Him and the girl dey laugh me say no man go gree marry me.

I wan ask people, na true say no man go gree marry me again? I regret everything.

Men, na true say una no go gree marry am again?

Make una advice her. 👈

22/05/2026

God morning my neighbors. Ekwnubialam too cry ooooo.

21/05/2026

Come join mama Ekwnubialam cook ogbono soup.

21/05/2026

Anytime I over sleep because my mother no wan wake me up, once I make up, the first thing I dey do with sleep eye na to ask my husband "where is my baby"?😂

21/05/2026

Since 4am wey Ekwnubialam wake up, him no gree sleep again. Him just dey chop chop. Him no dey cry.

Him eye just dey shine like Policeman touch.

Him just dey look us as if we wan se|| him papa property and him dey keep watch night.

20/05/2026

I go show Ekwnubialam face ooo

20/05/2026

Mama Ekwnubialam, abeg, I need help and advice.

Anytime I see my husband younger brother, I go just w,ett for my kpekus. Everywhere go soft. I no know why.

Because of this thing, I no dey gree near am or talk to am again. Na him senior me but when him greet me, I no dey answer am but the thing never stop.

I no dey feel like this when I dey near my husband. And the boy never tell me anything before.

I just dey messed up. I need help from people.

20/05/2026

Aunties and uncles, how una see my new cloth cover all?

Help me thank my mama and papa.

Ekwnubialam serving sweet boy goals.

Want your school to be the top-listed School/college in Port Harcourt?

Click here to claim your Sponsored Listing.

Location

Website

Address

Port Harcourt
500102