Joyful Stories

Joyful Stories We create and write stories and articles that uplifts the Soul

Follow me for more Christian materials in pidgin English
20/08/2026

Follow me for more Christian materials in pidgin English

BOOK TO USE OPEN HEAVENS EVERY DAY

DATE: THORSDAY 20 AUGUST 2026

TOPIC: GOD KOVENANT TO MAKE MONEY

KARRY FOR HEAD:
‭Deutronomi 8:18 pcm‬
[18] Una must remember di Oga una God, bikos na en dey give pipol di pawa to make money. If una obey am, di kovenant wey E make with una grand-grand papa, E go make am happen for una life.

BAIBUL READING: Job 36:11-12 pcm‬
[11] If dem hear God word kon serve am, dia life go get peace and dem go prosper.

[12] But if dem nor gri listin to God word, dem go die and dem nor know anytin before dem go where dead body dey.

DE TALK:
Wen yu enta covenant wit di Oga kpata-kpata wey get di eart and evry tin wey dey inside (Salm 24:1), the Oga wey get all di gold and di silva (Hagai 2:8), En go make yu get moni wey not karry wahala folo gom bodi (Proverbs 10:22).

Di devul dey like use promise of plenti moni make pipol enta kovenant with am. But dat kaind money karry plenti wahala.

I rememba di stori of one man laik dis, wey go meet habalist, kon enta kovenant with plenti bad spirit so dat dem go give am plenti moni for seven yers, after dat en go kpai. En swalo sharm wey di habalist give am, but en no get di moni, insted dem kon dey caunt seven yers for am to kpai.

Wen e remain some days for the seven yers to end, di man run enta shursh kon tell us en story, na so we tell am to give Oga Jisos en laif say Jisos go take kover for am, en kon gree. We pray for am sharp sharp, for every bodi eye koro-koro, en kon vomit the sharm wey en swalo. Na so we folo am happy, afta dat, en kon dey kom shurch wella.

Afta som time, en kon stop to kom, we kon arrange to go visit am. Wen we visit am, en tell us say the habalist say en no swalo the sharm wella, so en don give an anoda sharm. E no tey, di man kon get plenti moni.

Wen di seven yers wey dem give am for di kovenant don dey expaya, en kon tell en sef say "Di kovenant dey hia for Naija. I go travul go Lorndon and the bad spirits no fit tosh me dia"." But en kpai for plane wey dey go Lorndon. Na only God kovenant for moni fit make persin rish and wahala no go folo am gom bodi.

Malakai 3:10 na very important pat for God kovenant for moni. Wen yu pay yur tait, God go open di window for hevun kon scata blessing for yur hed wey yu no go fit karry finish.

To folo join bodi, Provabs 3:9-10 dey ginga us to honor God wit any first tin wey we get. God nor nid any moni; En fit provaid for en sef wella, but En just want make we honor am.

My own persin, once yu dey for kovenant with God, En go provaid for yu and make sure say yu no lak any tin. I pray say yur laif go dey show God blessing in Jesus name

WETIN YU GO PRAY:
Baba God, abeg hep me to honor Yu wit de tins we Yu don give me.

BAIBUL READING FOR ONE YEAR:
JEREMAYA 50

WHO WRITE AM: PASTOR E. A.
ADEBOYE

HYMNAL 26 - THERE SHALL BE SHOWERS OF BLESSING
(1)
Blessing go boku evry wia:
Dis na di promise of luv;
We go get more taim to enjoy
N'awa Saviour go send am

Koros
Blessing wey boku,
We need blessing wey boku:
Small small ones just dey arand us
But na boku one we need

(2)
Blessing go boku evry wia:
Dem go revaiv us again;
For all di hills and di valley,
Boku blessing dey fall dia

(3)
Blessing go boku evry wia:
God, make e fall for-awa hed;
Give us make we bele full oo,
Kom show respect for Yur wod

(4)
Blessing go boku evry wia:
Abeg, make e fall today,
As wey dey call Yu Baba God
As we dey call Yu Jisos

BOOK TO USE OPEN HEAVENS EVERY DAY DATE: THORSDAY 20 AUGUST 2026TOPIC: GOD KOVENANT TO MAKE MONEYKARRY FOR HEAD:‭Deutron...

*BOOK TO USE OPEN HEVUN EVRY DAY (TEENS)*
TEENS OPEN HEAVENS DAILY DEVOTIONAL
TORSDAY, 20 AUGUST, 2026
TOPIC: VICTORY WHEN YOU DEY UNDA GOD

AUTHOR: PASTOR E.A ADEBOYE

KARRY FOR HED: ‭James 4:7 pcm‬
So, make yu give yorsef to God. But rijet di devil and e go run komot from where yu dey.

BAIBUL RIDING: Salms 37:4-5 pcm‬
[4] Make yu depend on God and E go give yu evritin wey yu wont.

[5] Make yu kommit evritin wey yu dey do for God hand. Trust am and E go help yu.

DE TALK:
To stay unda Baba God dey very important if you won get viktory as persin wey beliv for God. Any taim pipol quote today baibul verse wey we karry for hed , dem go only talk about the ending pat. But as we see for day baibul verse, befor persin go fit make di devul fly away from am after en don stand against am, dat kaind persin go fess submit to God kontrol. Wen yu submit to God and dey for En side, yu go win di devul. Wen you submit to God, yu go obey En komand and follow wetin En tell you.

David, na man wey dey for God herr, en be beta example of persin wey submit to God will. BAIBUL make us no say en make am for laif becos God dey en side (2 Samuel 5:10).

My beta pikin, if yu no say yur maind dey for God to hep yu make am for evry aria of yur laif, yu must submit to God kontrol.
Wen you submit to Him kpata-kpata, kon dey folo all en komand, you go win for dis laif.

DE KOKO:
Wen persin submit to God kpata-kpata, en go get viktory.

BAIBUL FOR ONE YEAR: Luk 3, Joshua 9-10

HYMN: I DON GIVE JISOS EVRYTIN
(ALL TO JESUS I SURRENDER)
(1)
I don give Jisos evrytin
I don give am for free oh;
I go luv and trust am always
Dey for En presence always

Koros
I don give Am all
I don give Am all;
Give Yu all of dem my Savior
I don give Am all

(2)
I don give Jisos evrytin,
I dey bow for Yu leg ohh;
I don liv all d sweet sweet tins.
Take me, Jesus, take me now.

3: I don give Jisos evrytin
God, I dey giv Yu my sef;
Make Yur love and pawa full me,
Make Yur blessing fall on me.

4: I don give Jisos evrytin,
I dey fill Yur holy faya
Salvation dey sweet me wella
Glory, glory to Yur name!

*BOOK TO USE OPEN HEVUN EVRY DAY (TEENS)*TEENS OPEN HEAVENS DAILY DEVOTIONAL TORSDAY, 20 AUGUST,  2026TOPIC: VICTORY WHE...

18/08/2026

Follow me for more Christian materials in pidgin English

18/08/2026

*OPEN HEAVENS DAILY DEVOTIONAL (PIDGIN)*

*DATE: TUESDAY AUGUST 18 2026*

*TOPIC: GOD COVENANT FOR PROMOTION*

*KARRY FOR HEAD:*
But Yu don make mi strong like melu wey dey bush and use oil wey fine pass, take anoint mi." Psalm 92:10

*BAIBUL READING: PSALMS 75:6-7 (pcm‬)*
[6] Viktory nor dey kom from east or west or from di wildaness

[7] bikos na God dey judge! E dey bring one pesin down and karry anoda pesin up.

*DE TALK:*
DI devul dey like use promise for promotion to make pipol enta kovenant wit am. For example, I don hia abaut cases wia dose wey dey for pawa go tell persin wey want promotion for work to enta evil kovenant tru secret cult befor dem go give am di promotion. My persin, if you ever see yursef for dat kaind gbege, abeg no enta dat kaind kovenant oo.

Today Baibul reading tell us say promotion dey com from God. Wen Him talk yes, nor body fit say no. Wen God redy to promote you, e no mata wetin any body won do bicos yu go rish di position wey Him won make yu rish. Him dey kontrol king dia heart; so, if anyone wey dey for pawa wan giv yu wotowoto, kon dey talk say, "Yu no go get promotion unless yu join us," stand gidigba as God pikin, no let dem shake yu at all. Just hold God, las las, yu go win.

E get one time wen one of my spiritual son com mit me say, "Dady, I don taya to stay for one place for long na: I won move forwod. I get interview tomoro, abeg pray for me." I reply am, "Make we pray" but him say, "No! Just talk som tin." Na so I tell am say di intaviu go go wella. Him go di intaviu, kon kom back dey happy. Him kon say, "Dady, I redy wella for di intaviu, but dem only ask me tri quetion: Wetin be yur name? Which post wey you apply for? Wen yu won start wok?" I congratulate am, him kon talk say, "Dady, abeg talk anoda wod." I agree kon say, "Yur promotion go dey sharp sharp." Di next day, Him kom back dey happy, dey dance, Him talk say, "Wen I start wok dis morning, dem kom ask me to go inside bodrum. Di pipol wey intaviu me di day before sidan dia, dem kon talk say, 'Our Managing Director resign yestaday. Yu redy to take di post?" I reply am, "Congratulations, dis one na sharp sharp promotion oo." Him kon talk say make I talk anoda wod, na im I talk say God go finish di gud wok wey him start for yur head. Di next day, him come back, di tin wey happen pass am ohh bicos dem don dobul him salary! Him kon talk say make I talk anoda wod, I just play play reply am say, "Yu won kolet the company from dia owner?"

My persin, I pray say my Papa go surprise yu with sharp sharp promotion in Jesus name.

*DE KOKO:*
Nor tin and no body fit hold persin wey God don redy to promote l..

*BAIBUL FOT ONE YEAR: JEREMAYA 47-48*

*DI PERSON WEY WRITE AM: PASTOR E. A ADEBOYE*

*HYMN 20: I’M PRESSING ON THE UPWARD WAY*

(1)
I kon dey press, dey go up up,
Dey rish new levil evry day;
Still dey pray as I dey go up,
“God put my leg for uppa grand”

Koros:
God karry me, make I dey stand
For heaven upa grand by faith;
Were luv and joy, and light full grand,
God put my leg for uppa grand

(2)
E no dey hungry my hart to
Stay for wia fear and doubt full grand;
Som pipol fit stay for dis place,
My prayer be for uppa grand.

(3)
I go rise far above dis earth,
Go rest under di cloudless sky,
Di pipol wey dey uppa grand
Go get p*s above earth gbege

(4)
I won waka go highest height,
I kno say di rod no go smoot,
As I dey go, my song go be,
God karry me go uppa grand

(5)
God karry me go mautain saidl,
I no fit claimb wit out yur help;
Wen I rish hevin, I go luk
Wit grateful har from uppa grand

17/08/2026

OPEN HEAVENS DAILY DEVOTIONAL FOR TEENS (PIDGIN ENGLISH)

DATE: MONDAY, 17 AUGUST, 2025

TOPIC: HOLD YUR BODY WELLA

AUTHOR: PASTOR E.A ADEBOYE

KARY FOR HEAD:
‭1 Korintians 9:27
Instead, I dey kontrol my body kon make am my slave, so dat afta I don prish di Good News give odas, God nor go rijet mi.

BAUBUL READING : 1 Korintians 9:24-27

Una nor know sey, wen pipol dey run, na only one pesin go win di race and di prize? So make una run, so dat una go fit win!

[25] Pipol wey dey run, dey train well-well, so dat dem go win crown wey nor dey last, but wi dey run for crown wey go last forever.

[26] So I nor dey run for nor-tin and I nor dey follow breeze fight.

[27] Instead, I dey kontrol my body kon make am my slave, so dat afta I don prish di Good News give odas, God nor go rijet mi.

DE TALK:
Sef-kontrol dey very important if you won becom great. To be great no dey com by accident; na the reward for standing gidigba, no shaking and to get hold yur body. If you wan make am, yu must dey ready to pay the price wey follow self kontrol. For example, if you wan make am for skuul,, you must dey kampe dey read yur book wella. Also, if you won do big big tins for God and enjoy Im greatness for yur life, then yu must dey pray, fast and obey God wella

My better pikin, yu no fit make am if yu no dey hold yu body wella. The devil go won deciv yu with social media, yeye friends and sweet sweet tins for this life, no give dat chance ohh, You must make sure say yu comot yur sef from any tin or any body wey won comot yur from God porpose

My person, God don ready better destiny for yu. Jeremaya 29:11 tell us say de plan wey Him get for yu na better one; dem go help yu make am for laif and give yu better future. Abeg, no let any tin disqualify you to rish di better height wey God don prepare for yu.

Dey hold yu body, dey pray make yur eye dey one place.

THE KOKO
To hold your body go open road for you to make am for this laif..

BAIBUL FOR ONE YEAR:
Luk 1:24-56 Diuteronomy 33-34

HYMN 1 AT THE CROSS

(1)
I no dey shame to show my God
Or to defend Im name
I dey honor Im word wella
The glory for Im kross

*Kọrus;*
For the kross, for the kross
Where I first see di light
The load wey my hat carry com comot
Now, I just dey happy evry day!

(2)
Jizoz my God, I know Yur name
Na dia I gum body
Him no go let shame catch my soul
Abi make my hope kpai

(3)
Him dey kampe as Im throne dey
Him go secure wella
Di tin wey I give Am to hold
Rish the very last day

(4)
Him go kary my yeye name
Tell Im Papa dat day
Na for dat new Jerusalem
Na-Im Him go give me place

17/08/2026

OPEN HEAVENS DAILY DEVOTIONAL (PIDGIN ENGLISH)

DATE: MONDAY, AUGUST 17TH 2026.

TOPIC: THE GAINS WEY DEY FOR GOD KOVENANT II

KARY AM FOR HEAD

If una listin to dis rules kon obey dem with all una heart, di Oga una God go really keep en kovenant wey E promise una grand-grand papa.
Diuteronomy 7:12 (PCM)

BAIBUL READING: JENESIS 20:1-18 ‭
[1] Abraham travel from der go Negev aria kon stay between Kadesh and Shur. As Abraham bi strenja for Gerar,

[2] e kon tell pipol sey Sarah na en sista. So Abimelek wey bi king for Gerar kon koll and take Sarah.

[3] But for dat nite, God kon appear to Abimelek for dream sey, “Na die yu won die so, bikos di woman wey yu take so, na somebody wife.”

[4] For dis time, Abimelek neva do anytin with Sarah and di king kon ansa God sey, “I neva do any bad tin! So Yu go just distroy mi and my pipol like dat?

[5] But Abraham tell mi sey na en sista and even di woman still sey Abraham na en broda. All wetin I do na with betta mind and I neva do any bad tin.”

[6] Den for di dream, God ansa am, “Yes, I know sey wetin yu do na with betta mind. Dat na di rizin wey make mi nor let yu sin against mi or tosh di woman.

[7] Naw, make yu give di woman back to en husband, bikos true-true Abraham na profet and e go pray for yu and yu nor go die. But if yu nor gri give di woman back to en husband, make yu know sey yu must die with evritin wey yu get, even all yor pipol.”

[8] So di next day for early morning, Abimelek kon koll all en savants. Wen e tell dem evritin wey happen, fear katch all of dem.

[9] Di king kon sey make dem koll Abraham kom. Wen dem koll am kom, di king kon tell am, “Wetin bi dis wey yu do so? Na wish kind bad tin I do yu, wey yu won make mi and my kingdom kommit dis kind big sin? Yu don do sometin to mi wey yu nor suppose do!”

[10] Den di king ask Abraham, “Wetin make yu do like dis sef?”

[11] Abraham ansa, “Bikos I feel sey nobody dey wey dey fear God for dis place and dem fit kill mi if I sey na my wife.

[12] Sarah na really my sista, my papa pikin, but nor bi my mama born am. I marry am

[13] wen God take mi komot from my papa house and I kon tell Sarah sey, ‘Anywhere wi go, di only tin wey yu go do to show sey yu love mi, na to tell dem sey I bi yor broda.’ ”

[14] Den Abimelek kon give sheep, kattle, man and woman savant to Abraham. And e still give Sarah back to Abraham en husband.

[15] Den di king sey, “Si, na my land bi all dis place wey yu dey si so, make una choose anywhere una like to stay.”

[16] Di king kon tell Sarah, “Si, I don give 1,000 silva to yor broda, so dat evribody wey dey with yu, go si and know sey yu nor do any bad tin.”

[17] Abraham pray to God and God kon heal King Abimelek, en wife and en wimen savants, so dat dem go fit get belle born shidren,

[18] bikos God klose dia belle make dem nor fit born, bikos King Abimelek bin kollect Sarah, wey bi Abraham wife.

DE TALK

Many years ago, e get one man wey dem sabi wella for one Islamic kontri, where to build church na gbege, de man kon invite one of our missionaries to start church for im yard. Wen de church start, na so I'm wife kon tell am say, "Wit yur position for government and say dem sabi yu wella for this kontri, yu kon still allow shurch to stay for yur yard?" De man luk im wife kon tell am say, "No try am say yu dey talk against dis pipol oo!" I beliv say de rizin wey make e easy for RCCG to plant shurch in dat kontri and oda kontris na bicos of de konvenant wey baba God get wit our Faunder, Pa Josiah Akindayomi.

One of de gain wey persin fit get tru kovenant wit God na say, yu go dey get better results wey pass the one wey yur mates dey get, as long as yu dey do your pat for the kovenant, God go dey give yu results wey pass your pawa. De tin wey dey had oda pipol go dey easy for yu bicos of Im kovenant with yu.

For Exodus 19:5, Baba God say, "If yu go kip My kovenant, I go make sure say yu becom special treasure" Dis one mean say pipol go dey luk yu, dey wonda why God kon luv yu too mush. Many times, I go wake up for night just dey tink about all the good good tins wey Baba God dey do for inside we shurch RCCG, I dey always say, "God , how yu kon luv us like dis?" Some pipol fit claim say na bicos we dey fast and pray wella, but I dey tell yu say, some oda pipol dey fast pass us well well. I remember wen dem just make me Oga kpata-kpata for we shurch, some of my friends join me pray for 36 hours no shaking, We tink say we don do wetin persin never do before, until we hear of de man wey pray pass us well well! Maybe I never pray for plenty hour like that man, but wetin Baba God don do for RCCG too mush and e pass wetin persin fit talk, plenty better tins dey wen persin get kovenant with Baba God.

Another gain wey persin fit get wen him and God get kovenant na protection. Wen d king take Abraham wife, God enter de mata, Him appear for de king dream. Him even kary de mata for head kon protect her, kon tell de king to ask Abraham to pray for am, as we take see for today's Balbul reading.
My Pesin, plenty good tins dey flow wen yu and God get kovenant.

DE KOKO
Plenty good tins dey and tins go easy for yu wen yu get kovenant with God.

AUTHOR: PASTOR E. A. ADEBOYE

TRANSCRIBED BY J O CHIDIEBERE

BAIBUL FOR ONE YEAR JEREMAYA 44 - 46

HYMN 19 - ROCK OF AGES, CLEFT FOR ME

(1)
Palee Rock, open for me,
Make I hide myself for Yu!
Make Yur water and Yur blood,
We dey flow from your body,
Kary all my sin trowey, Wash me comot for im pawa.

(2)
No be for my own pawa,
I go take dey do Yur law,
My gra-gra no fit help me,
My cry-cry no fit help me,
Dem no fit comot my sin,
Only Yu fit save me ohh.

(3)
I no carry-any tin com,
Na Yur cross I just dey hold,
I dey naked give me clot,
I need help, abeg helo me,
River no fit wash my sin,
Wash me God, make I no kpai.

(4)
As I dey breathe like dis so,
Wen I go close my eyes, kpai.
Wen I go go where-i no kno,
Kon see Yu for judgement throne, Palee Rock, open for me, make I hide myself for Yu

Address

Owerri

Telephone

+2347031583190

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Joyful Stories posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The School

Send a message to Joyful Stories:

Shortcuts

Share

Category