30/03/2025
Pls, check out my video
Dis page na to yarn law to my pipo with pidgin, to pieces the law make everybody Sabi am.
30/03/2025
Pls, check out my video
Una dey ask na wetin lawyers dey do sef? Make I let una know say na 3 pipo for this life wey you nor fit lie give. The first, you nor fit lie give your Fada for church during the time wey you dey vomit the bad things wey you don do. 2nd, na your doctor wey you sick kon go hospital. You nor fit lie give am how your bodi dey do you. The 3rd na your lawyer. You nor fit lie give your lawyer wen wahala don reach your domot.
Anybodi wey nor be lawyer make you try get one for corner because of any gbege. Make una just sidon. I go tell una small small tins wetin lawyers dey do.